Sunday, November 22, 2015

You can pray Psalm 23 in Pidgin English:

1. The Lord na my
shepherd, I dey
kampe.
2. E make me sidon for
where better dey flow yanfu yanfu. And come
put
me next to
stream make my body
thermocool.
3. E panel beat my soul
come spray am white, come dey lead
me dey go
through express road of
righteousness because
of Hin name.
4. Walaii! If I waka pass where arm
robber, 419 and juju
people boku,
come even join boko
haram reach
valley of the shadow of death sef, liver
no go fail me. Your rod
and staff nko?
Na so dem dey like
backbone dey
comfort me. 5. You don arrange good
fufu and Amala on top
table make I chop. See
bad belle
people dey look waa waa.
You rub me for head with vaseline
intensive
lotion. My cup come be
like River
Niger dey troway dey go.
6. True true, better life and mercy go
dey follow me till I
quench. And I go
tanda for God house... lai
lai I no go
comot for wia better dey.
God Almighty, Na you
biko!
AMEN.

No comments:

Post a Comment